Connect with us

Hi, what are you looking for?

Celeb News

Jerusalema remix by Burna Boy and Master KG dey burst fans brain

Burnaboy collabo with South African singer Master KG for di remix of im hit song Jerusalema dey totori fans.

“Jerusalema Remix” by Master KG feature di Nigerian singer and Grammy nominated artist, Burna Boy.

For di remix, Burna bring im Afro beat style to blend with multi-talented vocalist Nomcebo Zikode for di song.

Di original version of Jerusalema by Master KG get ova 26 million views already for YouTube.

See di reasons why Jerusalema remix dey burst fans brains

Burna boyImage copyright@BURNABOY/TWITTER
Image exampleBurna boy sing for Zulu and Yoruba for di jerusalema remix

Burna sing for Yoruba and Zulu

For di song Burna sing for Zulu wey be South African language and Yoruba to blend with di sweet voice of Nomcebo Zikode.

Burna voice dey on point

Oluwaburna voice, melody and delivery for dis song dey on point. Im vibe well with MasterKg South African sound and language wella.

Burna tok about im struggle

Di Grammy nominated singer lyrics tok about how in no dey perfect and im dey try to survive for jungle.

See also  Black Sherif enters the official UK Afrobeats Charts Top 10 for the first time With 'Kwaku The Traveller' and one more song,

Master KG wey get di song na one of di most decorated musicians of im generation, im win di continental and African diaspora Afrima 2018 Award for Best Electro and Dance; Afrimma 2019 Award for Best Male Southern Africa; SABC Summer Song 2018 for Skeleton Move; and di Limpopo Music Award for Best House Single for Skeleton Move.

How fans react to di song

Many pipo wey don listen to di song online dey hail Burna boy.

You May Also Like

Celeb News

Nulla pariatur. Excepteur sint occaecat cupidatat non proident, sunt in culpa qui officia deserunt mollit anim id est laborum.

Celeb News

Nemo enim ipsam voluptatem quia voluptas sit aspernatur aut odit aut fugit, sed quia consequuntur magni dolores.

Lyrics

Lyrics Zagadat It’s your boy Eazi (Yeah) Oh my baby eh It’s King King Promise (Yeah) https://www.youtube.com/watch?v=vsWSjKbxVJs Baby girl me I no go lie...

Entertainment

Ghanaian singer/song writer Mista Myles earlier this month via social media announced that he will be releasing his first body of work later this...

HTML Snippets Powered By : XYZScripts.com
Verified by MonsterInsights